Swearing In (ACAPELLA)

Flexy J

0 fans

Flexy J


3:26

 Become A Better Singer In Only 30 Days, With Easy Video Lessons!

I mustafa emeka olu oghenegare
I do solemnly swear
That I'll faithfully execute the office of the president of Nigeria
And will do the best of my ability
To preserve protect and defend the constitution of nigeria
Shut up

Time don reach when dem go stop
To dey swear in with bible
Dem go swear say dem go do heaven and earth
Tenure end nothing to show
So put bible and quran aside
Iman dress
Bishop dress
This na time to swear in with juju
We go swear dem by ourselves
Small small children
Old mama dem
Naked face you
Stand with one leg
Bend yanch face you
Begin swear you in
With big big juju
Amadioha ogun
Aziza ayelala
All the big big juju for 9ja
Nai dem go take swear you in
Make we see

Make we see
Make we see
Wetin go happen
Make we see the outcome
Because dem nor cor dey fear god
When dem swear dem in with bible
Dem go still increase oil price
Destabilize 9ja
Economy dey crumble
Now dem go dey use juju dey swear dem in
All the big big juju wen hate each other
Table your matter
Dem go kill you if you error for 9ja
When dem swear you in
You nor fit fulfill your promise
You don die ahhh
All dem old mama nakedness wey squeeze
With the small small children kwashiorkor belle
Gather face you
With their empty stomach
With tears from their eyes
Gather face you
Swear you in
And if you nor fit do wetin you promise
You go die put
Now see all of dem
Dem dey flex dey go
Embezzling strategies
Carry our 9ja money go other countries
Leaving 9ja people in these hungry streets
But now wen we wan start to dey use juju
Make we see wetin dem go do

Time don reach when dem go stop
To dey swear in with bible
Dem go swear say dem go do heaven and earth
Tenure end nothing to show
So put bible and quran aside
Iman dress
Bishop dress
This na time to swear in with juju
We go swear dem by ourselves
Small small children
Old mama dem
Naked face you
Stand with one leg
Bend yanch face you
Begin swear you in
With big big juju
Amadioha ogun
Aziza ayelala
All the big big juju for 9ja
Nai dem go take swear you in
Make we see

Dem go dey talk dey swear
Dey make a lot of promises
But wen dem swear dem in
Dem go fail all the promises
Tell me wetin go make 9ja good
When the people wen dey rule
Nor wan know if you get to chew
Ohh
Na that be the reason
Why we need this juju policy
Bad minded people go run away from politics
Swear in that man wen go make 9ja good
Provide jobs and a lot of food
And make the rich and the poor
Cruise dey deuce ohh
Ohhhhhh
Now election is by the side
People dey cast their vote
Some dey campaign
Yet dem still dey shoot people dey die
All the old mama and the kwashiorkor children
Dem don naked down
I hope you're ready for swearing in ceremony
Abi you change your mind
If i hear am
You get the heart
You get the heart
You wan die
This nor be bible and quran time
This na big big juju time
For your mind you win the election
Oya come here make you stand
Make we swear you in with juju
Make we see wetin you go do
Ohhh

Time don reach when dem go stop
To dey swear in with bible
Dem go swear say dem go do heaven and earth
Tenure end nothing to show
So put bible and quran aside
Iman dress
Bishop dress
This na time to swear in with juju
We go swear dem by ourselves
Small small children
Old mama dem
Naked face you
Stand with one leg
Bend yanch face you
Begin swear you in
With big big juju
Amadioha ogun
Aziza ayelala
All the big big juju for 9ja
Nai dem go take swear you in
Make we see

 Become A Better Singer In Only 30 Days, With Easy Video Lessons!

Written by: Justice Agege

Lyrics © DistroKid

Lyrics Licensed & Provided by LyricFind

Discuss the Swearing In (ACAPELLA) Lyrics with the community:

0 Comments

    Citation

    Use the citation below to add these lyrics to your bibliography:

    Style:MLAChicagoAPA

    "Swearing In (ACAPELLA) Lyrics." Lyrics.com. STANDS4 LLC, 2024. Web. 28 Apr. 2024. <https://www.lyrics.com/lyric-lf/10536807/Flexy+J/Swearing+In+%28ACAPELLA%29>.

    Missing lyrics by Flexy J?

    Know any other songs by Flexy J? Don't keep it to yourself!

    Browse Lyrics.com

    Quiz

    Are you a music master?

    »
    The song "Mockingbird" was written by...
    A Klade
    B Drake
    C Jay-z
    D Eminem

    Free, no signup required:

    Add to Chrome

    Get instant explanation for any lyrics that hits you anywhere on the web!

    Free, no signup required:

    Add to Firefox

    Get instant explanation for any acronym or abbreviation that hits you anywhere on the web!

    Flexy J tracks

    On Radio Right Now

    Loading...

    Powered by OnRad.io


    Think you know music? Test your MusicIQ here!