Zombie
Charis Daniel
The easy, fast & fun way to learn how to sing: 30DaySinger.com
Zombie oh Zombie Ye dey try to treat us like we be mumu Zombie oh zombie Every citizen gat a story to tell been ripped off our right some many things we still dey bear Freedom of speech no more cause we self we dey fear Make olokpa no gun us down because we won air out If we start to fight now them say we be mere tout Lazy youth na so dem call us because we no get mouth Happy independence but bro we no dey happy oh Flush all this bad government laws with harpic oh Zombie oh zombie Ye dey try to treat us like we be mumu Zombie oh zombie Brother man reason am Why be say dem dey start project weh dem no fit ever finish am Why be say dem give us power to vote and still dey rigid am Money lose money lose tell me who dey thief am E go better na wetin dem use to blind us fake promises every four years na so dem take dem bribe us Suffocating every citizen like we be titus and if we rant too much for social media dem pipe us Zombie oh zombie Ye dey try to treat us like we be mumu Zombie oh zombie Don't you ever treat us like we be mumu I hear say dem don pass bill I hear say dem don sign am I hear say dem fit badge in our doors now with no warrant I hear say we no fit look clean again and walk free say dem go pull up with their korope and we go pay fee No freedom of movement No freedom of speech and if you speak too much English dem go say you dey preach You better give us all the money weh dey for your account Or we go beat you so tae you go end up for six feet Zombie oh zombie Ye dey try to treat us like we be mumu Zombie oh zombie Don't you ever treat us like we be mumu
The easy, fast & fun way to learn how to sing: 30DaySinger.com
Citation
Use the citation below to add these lyrics to your bibliography:
Style:MLAChicagoAPA
"Zombie Lyrics." Lyrics.com. STANDS4 LLC, 2024. Web. 3 May 2024. <https://www.lyrics.com/lyric-lf/5257105/Charis+Daniel/Zombie>.
Discuss the Zombie Lyrics with the community:
Report Comment
We're doing our best to make sure our content is useful, accurate and safe.
If by any chance you spot an inappropriate comment while navigating through our website please use this form to let us know, and we'll take care of it shortly.
Attachment
You need to be logged in to favorite.
Log In