Chairman (& Dollar Grill)

Chief Priest

0 fans

Chief Priest


3:31

 Watch: New Singing Lesson Videos Can Make Anyone A Great Singer

Chairman o
I no dey loyal today
Chairman how you go like
To dey on the side of justice
Eli aiwa weru iway
We don tire to dey chop shit

Chairman o
I no dey loyal today
E get this matter wey dey worry me
Na about this our brother wey them dey call Ebube
I dey pass for road, people dey beatam
I say e ya... I knowam,  make una leavam
Them say him go thief pot of soup
I say chai... I give them money
I carryam go house
I reach him house, him mama dey for bed
She dey sick, she don almost rotten
I say how una dey treatam
Him say them no get money for hospital
Hey
Im sister sef dey sick, him dey alone
Him no get job
Mr. Chairman
Wetin we go do to help these people
Build them hospital, give them job
Ebube sef na electrician

Chairman how you go like
To dey on the side of justice
Eli aiwa weru iway
We don tire to dey chop shit

Ok
E no finish there
Now, we bring the woman and her daughter
Away from the house
We call neighbours, make them help
Na im neighbours come
Some neighbours talk say them too
Get  sick people for their house
Say them never chop
I say ahaa
We come hire more motor
Na wetin carry us come here
Chairman
You be our local government chairman
All the money wey we dey get
How many e dey
Na where e dey
Na who holdam
We wantam back, na our own
We go build for ourselves
Abeg Mr. Chairman
We no want insult you
But make you no insult us
We hearsay you carry our money build your own house
We dey thief for road
Police dey arrest us
We no get money for bail
Mr. Chairman

Chairman how you go like
To dey on the side of justice
Eli aiwa weru iway
We don tire to dey chop shit

Yes o
Chairman, you go comot hand for the leadership
You go step down
We no need who go school
We need who like us, who get conscience
We go help ourselve
No put your hand again
Nhnn
We go treat ourselves
Thank you

 Become A Better Singer In Only 30 Days, With Easy Video Lessons!

Written by: John Chinda

Lyrics © DistroKid

Lyrics Licensed & Provided by LyricFind

Discuss the Chairman (& Dollar Grill) Lyrics with the community:

0 Comments

    Citation

    Use the citation below to add these lyrics to your bibliography:

    Style:MLAChicagoAPA

    "Chairman (& Dollar Grill) Lyrics." Lyrics.com. STANDS4 LLC, 2024. Web. 7 May 2024. <https://www.lyrics.com/lyric-lf/5542866/Chief+Priest/Chairman+%28%26+Dollar+Grill%29>.

    Missing lyrics by Chief Priest?

    Know any other songs by Chief Priest? Don't keep it to yourself!

    Watch the song video

    Chairman (& Dollar Grill)

    16
    0     0

    Browse Lyrics.com

    Quiz

    Are you a music master?

    »
    "Say It Right" is a song by which female pop artist?
    A Nelly Furtado
    B Mandy Moore
    C Katherine Mcphee
    D Jessica Simpson

    Free, no signup required:

    Add to Chrome

    Get instant explanation for any lyrics that hits you anywhere on the web!

    Free, no signup required:

    Add to Firefox

    Get instant explanation for any acronym or abbreviation that hits you anywhere on the web!

    Chief Priest tracks

    On Radio Right Now

    Loading...

    Powered by OnRad.io


    Think you know music? Test your MusicIQ here!