Song parody of

God did o

by Jayluvoflyf

Here's where you get creative! Use our cool song parody creator to make a totally new musical idea and lyrics for the God did o song by Jayluvoflyf.

Simply click on any word to get rhyming words suggestion to use instead of the original ones. You may also remove or alter entire lines if needed — when you're done save your work and share it with our community — have fun!

  • English (English)
  • Français (French)
  • Español (Spanish)

Ehh eh they call me Jayluv Jayheyrecords Eh Dejinoni I see you How e for be ? If say God no dey for me God did eh shout out to dj Khalid Shout out to jayz lilwayne Rick Ross no be only you they no believe o Khalid Make I first tell una about the girl wey no believe me okay listen make you reason ah ah eh girls matter hehn e go be sha I dey talk am so make you no be like me make una learn check see ah As I buy you coke You say I broke You know me tey tey but u dey use me play You say we no be mate say we no fit date Cause money never dey & No be lekki I dey stay Hustle never pay So You no want stay You dey find ogz like them olamide Ogun babe but You no like Obalende That year you talk say jayluv we no fit dey You No want love Nwatiti like ckay After you make me go Gaga like Chudy k U turn me 2 crazeclown wey want catch ade But Levels don change now Na Uk i dey you don see am now eeh Woman matter hehn eeh how e for be eerr I know say now you go dey show people my picture dey tell them say I be your guy dey famz it's allowed flex my dear carry on listen see arh Okay when I rap Them dey mental from start I dey pass like say I dey for center Can you see me now omo dey feel me now Fans don choke dem plenty want see me now Haters Back then don dey believe me now Even wen I want unilag dem dey give me noun We dey do our own nobody dey beef them Taba gbori wole Like Soyinka we dey give dem Life no balance hustle no be beans Donjazzy where the kingdom Since your brother na prince Coming for the fame Coming for the paper The way we take dey shine you go think say we be nepa Mamacita dey talk say the boy dey vex her So I go ask wizkid If she get tiny temper (tinie tempeh) Naija na cruise but the life no funny Even sabinus know say josh2funny See how e go be if say God no dey for mee how e for be ah okay make I give una the verse listen you go like this one check see To wear eyeglass no be intelligence Nowadays Rich man na who carry benz Forward ever like say na film I get body like Iyke you go think say na Jim No pour me drink if no be Hennessy You no believe Ene only talk wetin Ene see Life of the party yes na me be that Okro wey no draw Sheybi e don win be that I be their parle g Forget biscuits Tailor own na thread I say make you forget the tweet When I go blow Shey make I go Iraq Konji dey everywhere check time 12 self dey knack Straight win like nadal omo we no dey deuce My kind of girl na that 1 wey go foot d bills My girl tight she no need to wear tight Portable lomo omo we no de fear fight I wear my brother fine shoe go show Cause no girl go send you if your face no show My babe sabi to dey give head She no dey disappoint she dey give me for my big bed I dey my girl side I no go sleep there I like my side but sometimes I dey pick there them dey look up to me like their desktop Life be like Uk bus na your junction you go press stop Nobody send you if you broke Them go laugh you cause without money you be joke Who die I say Nobody know Na who dey share akara now everybody know Stack the cash here buy the house there Red carpet here put the Rug or the tiles there My Upstairs get bar omo you no need to buy beer The standard idea na to get high there Na money make politicians want die there I make headlines omo I no need to barb hair But na 2k pounds Booking be the price here Guy no go buy ring what if she no talk yeah Yahoo messenger tell me na who send am Life no balance okay tell me na who scale am Money dey we no need that your 6 packs Na the girl wey you want follow waka we dey see pass Anini dey for school ein go thief pass Xavi Modric Fabregas they go tip pass Try get class No be everytime wey girl come your house na ein u self go dey shift pant Omo I fine I thank God say I fine Like do not urinate here na me be that fine Ogbono & okro no draw so na who win ? I go blow Rest In Peace osama bin laden The Greatest mistake is thinking u have time Na pride o make orange self grow pass lime My Balance been dey like radio frequency If no be God na since sapa for kill person Give Deborah Igbo and also Liz benson But when you begin smoke ciga Liz benson Iniquity for lab that one self Na Med sin medicine Science student these days no be who do medicine SA get Mandela Ghana own yveone Nelson No be everybody wey carry first na do lesson Life is not fair ask Nkechi blessing Even Ronaldo no go gree say world best na Messi Na Twenty eighteen Na I serve if no be God illiterate 4 dey use me dey laugh Good things dey take time Even award of this year na next year na you go collect am Thank God we don't look like what we've been through No be my song if jayheyrecords no dey the intro When I reach Uk na with Heathrow Forget pdp na me be the power for people You no show love i no fit vex o I go make am that one Na poor man manifesto No need for yeast if e no go rise Na since I small segun Arinze don open eyes Fireboy no be burnaboy Born am Chat wey don dey sweet you use billing spoil am You fine you still want fix lashes I dash you 10k you still say make I add charges No buy scent leave if e no get scent For uk who chop belle full get accents When I wake up omo I dey rush brush Cause street no dey sleep omo Na to rush bros Like brt driver wey commot bus Boys dey loyal if no be their corrupt boss Life be like dstv na multi choice Gotv No be stinginess we dey only cut cost So small time we go dey top cores For Top shores soon we go top Forbes We go be like sculptures Running top shops off shores they can't top us Like moving train they can't pause us Account surplus omo They can't stop us Na toilet I dey get inspiration Policeman radio self e go dey for station Freestyle na my own guy you no fit win Even though you go winners Chapel I say you no fit win For this rap Me I know the in and out o Na music drop my first Credit alert o erh The high table That's where I'm at o IBILE Lawa kapari marimari chipako The girl wey u want rock Na ein I dey fuck o But no be everything eye see mouth go talk o Na only real matters me I dey fit yarn Once if they hear my flow them dey feel am Liver pull for salah as we dey kill ram My ex no be Kim I for carry car dash am Your babe dey loose na Alum tight am Na you dey lose cause I sabi who dey light am Many giveaway online wey be audio Who I be me I no fit judge you o Normal Every man get him own hustle o I'm out like that Jayheyrecords Jayluv Errh

Done creating your parody?

Don't keep it to yourself! Save it now so you can share it with the rest of the world!

Browse Lyrics.com

Quiz

Are you a music master?

»
"Your out of touch, I'm out of time, but I'm out of my head when your not around" is lyrics from a hit 80's song by which artist?
A Hall and Oates
B Phil Collins
C Foreigner
D Air Supply

Free, no signup required:

Add to Chrome

Get instant explanation for any lyrics that hits you anywhere on the web!

Free, no signup required:

Add to Firefox

Get instant explanation for any acronym or abbreviation that hits you anywhere on the web!

Jayluvoflyf tracks

On Radio Right Now

Loading...

Powered by OnRad.io


Think you know music? Test your MusicIQ here!