October 1st
Chief Priest
Become A Better Singer In Only 30 Days, With Easy Video Lessons!
Mario, Coming for the party right Ok It's October First Independence you know You know To serve our fathers land October 1st make you wait first Na which kind independence Which kind independence I no feel no independent Where is the independence October 1st Is a fest for the big man with a Things in his belly Make you wait October 1st Every day for me, na the first day of the school First day of the life First day i gotha die October 1st, make you wait first Make we talk about the citizen first October 1st, them say Naija Na the time wey we get this independence Ahh I no feel like say i dey independent Nah I dey rely on my parents My women and my niggaz Them sef dey look up to Jehovah Some guy wey dey for up there With koboko in his right hand Make I tell you I no feel like independent October 1st But first The Dj wear some clothes wey them soak With the blood, but You no seeam Because you dey enjoy to dance in the graveyard Dance within your pain October 1st You could wear your king clothe Thank god for giving you food Wey meat no complete inside the food Listen, October 1st Make you wait first Boys dey vex October 1st Wetin you mean Aby na holiday wey police no go Gundown boys on the street for nothing Aby na when people wey dey sick Go get free medical attention October 1st make you wait first We need to talk afresh Maybe people wey been die before Them No been die for nothing But the thing wey them been die for E no come work out Because some people come From secret come take over Knock them off Like a military takeover You don see the result now We are democratically together In this hunger The man you been dey fight against Don come over, become your oga October first wetin you mean Oga wait first People first, my citizen first I need to reinvest on my interest Enjoy your wealth That comes from my sweat You see All those time that we bled It's nothing but for the respect Be that nation that heroes prophessed Where citizens have nice things to confess Oh We need to start afresh Na which kind independence Which kind independence I no feel no independent Where is the independence Independence for what Independence of mindset When yoy been dey fight The person wey you been dey fight Get im own culture When you free You still dey use him culture Your boys dey sing dey still dey sell im products Wetin dey worry you October 1st Independence from what Independence from your ancestors Look at your behaviour You act like you are on liquor They laugh you your neighbours Even your children dishonoured I know this is not your nature Chief priest, October 1st Everyday for me Na the first day of my life That i got to live I got to die I got to make decisions that affect my family October 1st, make you wait first We need to talk afresh Start from beginning, make sense Wetin be this sef If na fight We go go down, once more Make we taste wetin e feel to be freeborn Freedom from what Freedom to live with my family Very happily With nothing to be fearing we Ahh October 1st Everything wey una achieve Na shit to me Even patriots dey look for way to leave Their god given country October 1st na corruption wey you achieve Yes, na wetin you achieve But you get time to change BCuz even god make us free Give us independence Carry your people first Africa first, because they need you Na which kind independence Which kind independence I no feel no independent Where is the independence
Watch: New Singing Lesson Videos Can Make Anyone A Great Singer
Citation
Use the citation below to add these lyrics to your bibliography:
Style:MLAChicagoAPA
"October 1st Lyrics." Lyrics.com. STANDS4 LLC, 2024. Web. 11 May 2024. <https://www.lyrics.com/lyric-lf/5538519/Chief+Priest/October+1st>.
Discuss the October 1st Lyrics with the community:
Report Comment
We're doing our best to make sure our content is useful, accurate and safe.
If by any chance you spot an inappropriate comment while navigating through our website please use this form to let us know, and we'll take care of it shortly.
Attachment
You need to be logged in to favorite.
Log In