PTSD
Acelord
Watch: New Singing Lesson Videos Can Make Anyone A Great Singer
Dey call it PTSD But I'm just happy I'm free Blind folded for like 3 days bros I no bin Dey see Dem bin tie us like thief But na we dem Dey thief If 20 million no come out we go kill you by next week Me wey Dey ball Dey thank God say we don Dey Friday dis week Na that time I truly feel! I kidnapping Dey be Na codeine carry us commot house bros we just bin wan sip Young rich fly niggaz all gold everything It was 2016 Dey caught a nigga sleeping I know say e don red Wen den kidnap me and my g Nothing wey we no see One of d boys name na small shit Start to rub my nigga bears Dey call my guy him hubby No b story i Dey form dis time was really ugly Dem put gun for my head Dey tell me call ur mummy If dem no pay d ransom We go cut all your body Sell am give all dis ritualist Just 2 make our money We no Dey play bros u see dis our hustle no funny Na do or die so u better start 2 Dey beg ur mummy We no play Wetin we like hear Na oga I go pay Or d money don Dey for road Dey come we no like delay Dey call am PTSD But I'm just happy I'm free Blind folded for like 3 days bros I no bin Dey see Dem bin tie us like thief But na we dem Dey thief If 20 million no come out we go kill you by next week Me wey Dey ball Dey thank God say we don Dey Friday dis week Na that time I truly feel! I kidnapping Dey be Na codeine carry us commot house bros we just bin wan sip Young rich fly niggaz all gold everything 10 hours no b joke we still Dey waka inside bush Una go die today na we talk am No b Bobo juice Meanwhile I just Dey tink of all d bad tins wey I don do I no join cult I no rob I no kill wen I bin Dey school So wetin sup Baba God y your pikin go die like dis 4th day inside d bush Bros na ground we bin Dey sleep All d bread we bin Dey chop D crumbs near were we dey sleep Na that night soldier ant see 2 to come out no b beans 2 hours later later omo you need to see d rain wey fall E b like all d angels for heaven agree to cry by 4 No b say I like 2 stop but d story Dey too long
Struggling with PTSD? Become a better singer in 30 days with these videos!
Citation
Use the citation below to add these lyrics to your bibliography:
Style:MLAChicagoAPA
"PTSD Lyrics." Lyrics.com. STANDS4 LLC, 2024. Web. 21 May 2024. <https://www.lyrics.com/lyric-lf/6182624/Acelord/PTSD>.
Discuss the PTSD Lyrics with the community:
Report Comment
We're doing our best to make sure our content is useful, accurate and safe.
If by any chance you spot an inappropriate comment while navigating through our website please use this form to let us know, and we'll take care of it shortly.
Attachment
You need to be logged in to favorite.
Log In